Lucky for you

Lucky for you, my maale born pikin
Try dey whyne me from time to time.
My cheeks go reddd like fresh tomato
If me and you dey, I no go too get sense.
Your matter no fit tire me. Na to de jolly your heart.
Lucky for you,
My love no get measure, e fit cut scale
I like to dey take pictures of person wey I love.
Na mad picture and video i sabi oh.
Na me go lie down for ground, put phone one side, twist neck
I no even dey look if person dey pass.
The koko be say i mustu capture you weh-weh.
E remain small a-fo do photography.
Lucky for you, I too like gist.
Any gist wey dey this world, you fit asss-me
Me and you go dey gist fire.
Even the ones wey you sabi, I do listen
From podcasts oh, to CNN oh, to Nat-Geo wild oh
We go discuss am. Me and you dey.
E go dey sweet me make i dey look you for eye as we dey gist.
Lucky for you, I fit rap
No any rap song wey I no sabi
Lil baby oh, Nicki oh. I fit beat them for you.
Anytime wey you no well, just buzz me
My rap game na healing machine.
Na me be bad beeshhh.
Lucky for you, I no too like vulnerability
E dey do me one kind
But for you, I fit change.
Make I de tell you things
Wey a-no fit tell person.
Make I dey buzz you if anything show
For you I sure say I go do am.
Lucky for you, I fit fight.
Na me be boxing machine for primary school
I no dey use my person play
If anybody try rubbish, make i know
For you a-fii box person papa.
Na me and you.
Lucky for you, it’d be anything for you🤎